Joke in pidgin - Food explorer

#Joke_Pidgin

E get one particular restaurant wey i dey
go chop 4 G.R.A. E get one oyinbo wey dey always come chop there
too...
Anytime dis oyinbo chop finish, he go shout ''Hey'',
so I wonder wetin dey make am shout. I
decided to chop wetin d oyinbo dey always chop so maybe me self
go shout too. When I reach d restaurant yesterday evening, I order
wetin d man dey chop.
Dem tell me say na chicken & red wine,
so i chop am finish, i no shout. I collect extra plate, but i no still
shout. I
say dis oyinbo na mumu o, wetin dey make am shout like
dat? Na so i just vex ask 4 my bill. The
waiter tell me say one plate of chicken & red wine na N85,000 then d
extra plate too na another N85,000. Na then I shout hey! heyy!!
heyyy!!!
heeeeeeeeeeyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyy
yyyyyyyyyyyyyyy
yyyyyyyyyyyyyy yyyyyyyyyyyy...........


Up till now, I still dey shout ....

Don't visit:  www.9jaBoomBox.com

Post a Comment

0 Comments