1. Man wey naked no dey put hand for pocket.
loose translation: You can't do somethings if there are no certain conditions.
2. Chicken wey run way from borno go Ibadan go still end up inside pot of soup.
loose translation: You Can't Run Away From Your Destiny
3. Today’s newspaper na tomorrow Suya wrap.
loose translation: Keep calm! Nothing lasts forever
4. Cow wey dey in a hurry to go America go come back as corn beef.
loose translation: Just be patient. Let the game come to you. Don't rush!
5.Akara and moin moin get the same parent na wetin dey pass tru make dem different
loose translation: How you start doesn't matter, what matters is how you finish.
6.Wetin concern agbero with twitter handle,or malu/ cow with face cap?
loose translation:Mind your business.
7. If life dey show you pepper,my guy make pepper soup from am
loose translation: Make something good out of a bad experience
8.I get am before Nor be property
loose translation: stop living in the past and start living in the present.
9. If person too tey for party e go follow dem wash plate
loose translation: Don't outstay your welcome
10. Rolling stones, ofcourse na person push am now!
loose translation:There is always a reason for something
11. Craze no hard to form,na the trekking be wahala
loose translation:Easier said than done
12. No matter how hot your temper be,e no fit boil beans.
loose translation: Calm down,your temper won't solve the problem
13. Every mallam with im own kettle,every aboki with im own radio.
loose translation: Every man for himself
14. You no need cutlery to chop slap
loose translation: You don't need my translation to understand this,lol
15. Okpolo eye no be open eye
loose translation: Having Big eyes doesn't make you civilised,lol
16. Leave matter for Mathias and Sabi for Sabinus.
loose translation: Give everyone what they deserve.
17. Bring suya, bring suya,.......na cow body dey suffer am.
loose translation: Every action has a consequence
18. E go better na e go better,na im make ibo man still dey Kano
loose translation: When there is hope,there is Life... 👉👉👉
0 Comments
Good day precious one, We love you more than anything.